E get wetin some boys dey do wey dey vex me ehn. Wetin go make boy - TopicsExpress



          

E get wetin some boys dey do wey dey vex me ehn. Wetin go make boy borrow N100,000 just to impress girl, unto say, him go book flight tickets for the babe. The one wey dey taya me be say, after the babe go and the guy no fit pay him debt....na so him friends go come him house come carry him home theatre and some clothes and snickers/shoes. Some boys dey shame to show babe their house, when them invite their mammies, na for their friends house dem go go host their babes, and some go claim say na their house be that o. Ehen, some go invite their babes make dem show for their Papa burial, unto sympathy things na. No be say na their Papa die oo, na their friends Papa wey die and unto say their friends get pepper and dem follow wear uniform, those guys go lie to their babes say na their Papa die....Chai. My brothers, make una try to be real na. We know say some girls like lies and money, but some like boys wey dey honest. See, make I tell una wetin babes like; Ehen, babes like boys wey dey real and wey get one small dream wey him dey pursue. Una no know say babes dey derive joy if them put hand make your dreams come true? Make una dey there na, dey lie anyhow. My brothers, see, if any babe no gbadu you because your house no good or you no get money; bone her joor....na she fine pass for Nigeria. Make she carry her big head go joor. Shey I been tell una of one Linda wey come my house, and she no gree enter my house unto say my house no make sense? Una remember shey? Ehen, babe wey fine pass Linda 100times, come my house, sidon eat food. Mtcheeeeew, who send Linda. Wetin I just wan let una know be say, no be all Ladies dey like lies and Money. Plenty babes dey wey no send your money at all, fine babes fa. If una meet any babe, just yarn am wetin dey, make una no try to impress babes come dey form Governor pikin them. Just be your real self and try get one small dream or ambition wey you dey pursue, and she go dey happy to key into that your dream....and you go see say she go like you die. Any babe wey fashy you, no vex, keep being real....better babe go come. Una hear shey?
Posted on: Mon, 16 Sep 2013 19:11:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015