E ma be mi ooo!!!!!! Beeee ba be mi ju, beee lo mi o ni gba!!!! - TopicsExpress



          

E ma be mi ooo!!!!!! Beeee ba be mi ju, beee lo mi o ni gba!!!! Me!!!! Gree!!!! Lailai faabadaa!!!! I no force una do wedding ooo!! U say u wan do wedding. I no vex, i agree... U say u go sell aso ebi... I no vex!! I agree... U say opa kan, one yard na 5000naira, i asked u say shey e not too much... U say e not too much, u say u want ur wedding to be the talk of the town... I no vex... I go borrow money, i buy six yards. N30,000.. U say we go buy shoe, N10,000.. I no vex. I collect loan.... I buy am.... U say cap na N2,000... I find money give you.... I cum the wedding... Na only chivita and french fries i chop when i dey expect serious amala and concentrated obe gbegiri... I manage am because u say na modern wedding... I no vex. After just six months... Pere!!!! Just six month pere!!!! Una come say una dey consider divorce?!!! When i never even pay the debt and loan finish:....... Divorce abi!!!!! Oga ade..... Pay me my money jare!!!! U think say i no get sense abi!!!!! Make anybody no beg me oooo!!!! Na supreme court straight!!!! Ko jo rara... Maaa gba owo mi leni...:]X #Happ@>-- Weekend:D #Demayor
Posted on: Sat, 13 Sep 2014 09:52:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015