ENTERTAINMENT NEWS/UPDATES 10/5/2014 Report reach us - TopicsExpress



          

ENTERTAINMENT NEWS/UPDATES 10/5/2014 Report reach us say the marriage for Sapele Athletic Club today na bomb. The food sweet like TOFI sweet wey dey get many colours den wen we dey Primary School. The drinks sweet like Honey and na so the DJ just dey flow like say nai be DJ for Heaven. The Bride senior brothers wey dey U.K just dey Jolly wit NBM songs for the ground as deir cufra group members just dey nack hands for air for public. If nor be say na wedding i for call Army for dem bcos dem dey pollute the young ones mind wey dey around. The other wedding for Club na highest. The Decoration fine pass Hampshire interior and the Groom suit cost pass Range Rover 2014 wey my smally buy. The Bride fine like Ogbanje wey dey share blood power for water. Na the caterer food wey dey cent like Manner nai i use eat 6 plates and I drink 9 can drinks. The Photographer of dis party nor know work but e try and the way the bride dey roll waist mean say the groom enter big trouble for House and e nor go good make d groom leave the bride for House go work except say the compound wey dem dey stay,nor get neighbours. Report enter studio say IMO Association of women nai do their 30th Anniversary for Urhiapele Primary School today. The groove gada so many big wings of IBOs from within the town and outside the Town. Apku and Ofolugbo just dey fly like breeze without control as IMO women dance deir body break today. The Gbedu experience donations becos Ibos nor dey do groove without donations. Report enter studio say One fine babe wey beautiful like Queen of De Cost nai wed for Peemos today. The gbedu carry crowd wit big names from outside town mostly. The venue, decoration and the gbedu cost pass VENZA. I use smiles take commot dere becos wine wan kill me. The Girl senior brother just dey throway wine for me wen e see my I.D Card say i be Chief Okpubuluku. Na 3 Red wine and 2 Red Label nai i use wash mouth before i commot from d venue. The marriage wey dem do for Oleh Road wen make dem block road and dem nor pay Local Govt Revenue due to the influence of deir Inlaw Chief Monday Igbuya. The rice sweet like sugar cane why d owo soup bam like fuel wey dem mix with bagon. I just tire for party wen i see the Girl beads becos the beads heavy pass GP tank. Na so dem dey look face dey share food like say na everybody nai dem invite, wen dem know say pipo wey dey pass see canopies must branch. Na ufurukpe style i take commot after i eat 4.5 plates of food and 2 litre of Coke. Na James Iwo nai do marriage today for Catholic Church wey dey Yoruba Road. Everywhere bam for d party like Bama Myonaise. The rice sweet like sweety as d onions really catch am well. Drinks surplus and d tin cold well. D owo soup thick like cement wey dem mix with sand. Na so babes full d ground. I norva see DJ wey play musik reach dat DJ once, only say d guy nor dress well. Na yellow girls wey wear rubber yanch nai plenty pass d black ones for d ground. I tire for d way d MC con dey pray for one girl wey catch flower say d girl must marry dis year, na dat part let me burst laff commot as d girl just kneel dey shout Amen oh Amen oh. Report enter studio say some group of women wey be PDP faithful loyalist dem don resume the sweeping of the major roads wey dey Sapele, as dem dey sweep d sand dey gada. Dis na scheme to empower women for our Locality. Report reach us dis morning say gbege shele for Ajogodo opposite Monday Igbuya filling station and d gbege still dey go on wen Victor Asikolo wey dey use d vigilanty motor wey dem give am for security reasons but e dey use the motor dey shuttle Foodland with different babes enter d ground but e just drive commot without any major support to curb or maintain peace for d place. *ATTENTION (MISSING ITEMS) One small girl wey be Ten Yrs old wey dem dey call Harite Orugbani forget her school uniform, books & bag inside taxi yesterday at about 7pm wen she & her mother dey come down from d taxi along Okpe Rd by Otomewo. Dem enter d taxi for Boyo Rd. Anybody wey see the items or anybody wey know of any driver wey dem forget goods for e taxi, make d person contact dis Numba- 08036781099 or 08073395414 AUSTINE BOYO DON HIDE MARRY AND WE GO GIVE UNU D FULL REPORTS AND ODA MARRIAGE REPORTS 2MRW. GOD BLESS SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 10 May 2014 19:51:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015