FEDERAL GOVERNMENT SET TO STOP THE SALES AND CONSUMPTION OF KPOMO - TopicsExpress



          

FEDERAL GOVERNMENT SET TO STOP THE SALES AND CONSUMPTION OF KPOMO IN NIGERIA Hmmmmmm, na with heavy heart na im I want take drop this tori for una o, cos Federal Government don dey take style the conclude their plans to ban the sales and consumption of hides and skins (kpomo) for Naija o Na the Minister of Agriculture and Rural Development, Dr. Akinwunmi Adesina na im drop the tori for the 3rd joint anniversary of the Animal Science Association of Nigeria (ASAN) and Nigeria Institute of Animal Science wer hold for University of Ibadan o. Him say farmers n producers go make more profit if them turn the skin into leather n other products like belt, shoes, hand bags n plenty plenty other things o. Hmmmmmmmmm, like say if them turn the kpomo to belt n shoes we go still dey get them for the same price wer we dey get kpomo for market. Like play like play poor people like me no go dey see better cheap things eat for this our Naija again o. Since wer them comot oil subside for garri, garri maintain im black market price till today n now them want stop the consumption n sales of kpomo for Naija. Those of una wer be family friends with vegetable soup like myself know how this move go affect us... But God dey sha.
Posted on: Thu, 11 Sep 2014 07:35:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015