Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. One of the - TopicsExpress



          

Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. One of the popular chapters na psalm 23 reads:- 1.Baba God na my shephard, i dey kampe. 2. E make me sidon for where betta dey flow, come put me near stream make mai bodi thermacool. 3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey carry me dey go through express road go meet righteousness, sake of Im name. 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so dem dey like back bone dey comfort me. 5. You don prepare beta food on top table make I chop. All mai enemies dey look waa waa, ** mtcheeew long throat**. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. Mai cup na River Niger wey overflow im bank. 6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO, AMEN
Posted on: Sat, 22 Jun 2013 13:56:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015