Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. One of the - TopicsExpress



          

Finally the new NIGERIA PIDGIN ENGLISH BIBLE is out. One of the popular chapter na ... psalm 23 reads:- 1. The Lord na my shepherd, i dey kamkpe. 2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermocool. 3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Him name. ... 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people borku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me. 5. You don prepare good food on top d table make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank. 6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO AMEN. —
Posted on: Tue, 06 Aug 2013 09:35:32 +0000

Trending Topics



Tempest Mech:31 33 34 33 00 00 00 00 00 00 00 00 00 00 00 00
SAD BUT TRUE ~ HOW TO BECOME A BAD LOSER Av Helene - 2013-10-24
It is with great sadness that we bring the sad news that a long

Recently Viewed Topics




© 2015