From my guy, Tiamiyu Oluwaloni: *U used BlackBerry to oppress, now - TopicsExpress



          

From my guy, Tiamiyu Oluwaloni: *U used BlackBerry to oppress, now everybody has a Black Berry. *You used your Camry to Buga, now Boys use Camry to do Taxi. *Before u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch Ball for Buka and Mama Basira Shop, *Before u dey use your ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry comot for house, *Before u go dey use Brazillian Hair dey form Big Girl, Secondary School Student don dey wear am troway, *Befor u dey go Vacation for UK dey talk pass yourself, Boys don dey Buy 1st Class Ticket dey enter London just to go lick Ice Cream. BOTTOM LINE: No dey over do like say dat tin no go reach another person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean.. not forget say Tortoise Car na Big Man Motor before o.. Nothing wey come wey no get expiring date, even the Life u havena borrow you borrow am.. Humility na the Best Choice!!
Posted on: Tue, 11 Jun 2013 12:59:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015