Good Neighbour Things... (Non-Fiction) - Babe, see wetin - TopicsExpress



          

Good Neighbour Things... (Non-Fiction) - Babe, see wetin happen to me dis morning. - Wetin happen? - You know dat black gown I buy yesterday evening for market? - Yes. Wetin do am? - I soak am for water o, come wash am around nine yesterday night. Dis early morning wey I wan go check am, di tin done shrink weh-weh. - Are you serious? - Yes now. Hmmm, babe, e be like say na human being wey I go kukuma buy for inside market. You know say na for evening wey I buy di cloth. Maybe say na witch wey sell am to me. - Na wah o. - I no know wetin I go do now. - Hmmmm. Well, fesh some anointed oil, sprinkle di cloth wit am, den go burn di cloth. I go join you, make we both pray in tongues as we dey do am. - Abi? - Before nko? See, di bible say dat when two or three are gathered in my name, God is there. No witches and wizards go fit harm us if di two of us pray together. - Yes ooo. All dese witches and wizards mus fail in Jesus name. - Amen o. - I dey come. Make I go get di anointing oil and lighter. - Carry kerosene come too. - Okay. I dey come. You see? Na why I dey speak of you. You be my only sweetheart. - Lol. Go bring dem come jor. Funny girl. I be your sweetheart? You done forget your boyfriend, come dey call me sweetheart? Lol. *La Fin* And we wonder what is wrong with the country? Na wah o.
Posted on: Tue, 01 Jul 2014 08:14:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015