Good evening & happy weekend. How is everything today? I hear from - TopicsExpress



          

Good evening & happy weekend. How is everything today? I hear from people that u dey murmur, you dey complain and you dey grumble that you NEVER HAMMER. Na True? So, u no thank God ehn! U think say to see September 2013 na moimoi or small thing? Boko Haram reach ur side? U dey 4 Dana Crash? Aluu community pple catch u? U no hw many humanbeing way die in 2012 and even 4rm dis year January till nw? Answer me naaa *...* God give u good health. Naija no good, Naija no good: u dey use blackberry, ipad, Iphone, Galaxy tab, Android and laptop, If at all u neva get money to buy car or build house. Abi u don see where person wey dey coma hospital on sick bed dey do whatsapp? Abi na blind man wan change DP or used BBM? or comment on facebook status , u still dey complain over there abi? Abi u don see where dead body dey read facebook and ping or whatsapp 4 coffin? You better Start thanking God now... if u read this message and u no re-post am that means you no dey appreciate GOD.. Oya send am to all ur contacts. Thanks and Glory be 2 GOD for our lifes oo. Lord I thank u ooooo... Me don send my own
Posted on: Sat, 28 Sep 2013 17:13:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015