Gospel in Pidgin English My people, I de hail una o,na sake - TopicsExpress



          

Gospel in Pidgin English My people, I de hail una o,na sake of se we all b youths na him make I wan sama una this ghen ghen Tori wey breeze me.. I de prepare the apologize wey I go give who no understand me... abeg take malt drink, e de cool body... e no get who them give sugar e vomit am o except say e get diabetes.. oya make I nack una the yarn. Who wey get ear make e hear oh. King Solo wey be Solomon, man wey GOD take wisdom do hand bag e no crase put before e talk say, who wey think to do bad thing e Don do am already...and na sin,yes na sin My guy,you wen see that babe start de take eye comot e cloth de happy for your mind na sin be that.. you when done reason as you want take find way rush money hammer folo Apian way na sin be that. Sis, nobi every talk you go put mouth shoo! , oversabi na palaver give brain o,sake of say any matter way land gbawai u go full ground brekete chook mouth n tomorrow if de block you, you go deny am,na sin b dat, as talk de bring talk na So sin de carry him followers join body... you way look Anita your neighbour, she greet you, you smile answer but for your mind,you de think to sama am one back hand slap, Oga Solo say na sin u commit Because as you think am,u done do am..this man wey sabi talk am put for Proverbs 24:9oya if this pattern of Gospel do you tuwele for body oya rush make u arrest your Bible, detain Proverbs 24:9 comment wetin e talk put for our comments box oya sharply, if u fit sama am for pidgin e go make sense pass. Thank You.
Posted on: Wed, 20 Nov 2013 03:16:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015