Gud afternoon my people hmm sorry I mean gud mornin..our pple say - TopicsExpress



          

Gud afternoon my people hmm sorry I mean gud mornin..our pple say pikin wey mama nd papa neva give name nobodi get right to give am name..na still our elders dem still talk am say man wey train he pikin how to shoot gun early age should b able to know wetiin d pikin go become for future...married woman wey go sleep with another man for outside wich kind name she want mke dem call her husband?some people go say d man no get prick while others go say na fustration some go say d woman na ashawo..anyhow as una talk am Egberigbolo d husband and d wife...yes wen woman dey behave. Like man na mamaG our people dey call her...he get one fat ijaw woman wey dey benin road opposite victory family church.. Her name na mamaG I no even know say such ijaw woman dey dat area my frends just carry me for car wey he papa die leave for am he com carry me go dere say mke we go high small wen I reach dere na dere I know say all dis our ijaw brodas wey dor marry nd some wey neva marry includin some wey do amnesty na there they dey spend all their money dis woman dey sell agbo(igbo root) mamG no b u be d first peron to sell igbo root me and my frend drink to say we com forget say we carry motor go dere...mamaG na only God know wetin u dey put for dat tin wey make am swit like suger bcuz of dis ur igbo root married men dey run leave their wife com sitdown for ur store till day dark.na only tamara go help our brothers
Posted on: Thu, 26 Sep 2013 08:11:32 +0000

Trending Topics



Its a free preview weekend for Starz so Glinda and I watched Thor
There was a man who received the ultimate testimonial in the New
EXCLUSIVE: Rangers chairman David Somers requested pay rise
An article about Valerie Jarretts role in the White House. Long

Recently Viewed Topics




© 2015