HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN YOUR IMAGE. By Dlite To mess for - TopicsExpress



          

HOW TO MESS IN PUBLIC & RETAIN YOUR IMAGE. By Dlite To mess for public dey sweet but if dem catch yo u, no be small embarassement o! Just follow dis guidelines & you are on your way to being a superstar in dis profession of messing. 1. Wen u enter a hall, check the wind direction,if na closed hall with air condition or fan,beta for you,dat na Maximum impact. 2. Make sure say you sidon face the wind direction. ... 3. Make sure say you get enough leg space,you go soon know why! 4. Form ajebo by crossing your legs every now & then. 5.You don ready to execute you suicide mission,try hold am until time wey the hall dey noisey incase your mess na the type wey dey sound like AK47 like my own. 6. Now carefully cross your leg, right over left. 7. Elevate the right yansh. 8. Release small small (sound check) 9. If no sound,that is,if na the one wey get silencer allow make the mess flow steady. 10. Allow time for proper circulation. NOTE: 1. Make sure say no be you be the first person to complain. 2. Wen people begin dey shout Jesus who do dis one,e no go better for the person wey do dis kind thin,simply ask why some persons no fit respect themselves for public places?na wa o 3. No shout pass odas o, if not you go become number one suspect. 4. Take style disengage from d area,relocate to another zone and repeat the exercise till the end of the event! Trust me,you will go places with dis your chosen profession. The world must hear of you more than Micheal Jackson....DONT BOTHER TO THANK ME,what are friends for?..
Posted on: Sat, 02 Nov 2013 07:07:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015