Henry don put sand for Suarez garri.... Liverpool Oga pata pata - TopicsExpress



          

Henry don put sand for Suarez garri.... Liverpool Oga pata pata John Henry, don comot yarn say lai-lai dem no go sell Luis Suarez for dis transfa window we dey, and e go be serious yawa if dem alow am go join dia Premier League rivals Arsenal. De Oga sef tok hin own afta Suarez open hin mouth for public tok say hin wan leave Anfield take find team wey hin go fit play Champions League, and Oga Henry sef come tell media pipu wey dey Liverpool side say "we no go sell Luis." Arsenal don alreadi knock door,drop £40 million for Suarez, but Henry tok say, dat oneno go ever hapin, say dem go sell dia best playa take give anoda club wey dey find space to play Champion League like dem. De Liverpool Echo bin qoute Henry dey yarn say " na serious yawa to sell Luis go club wey be our rival for position for table." Oga Henry still come yarn say hin believe say dem fit convince Suarez make hin stay still tap ball for Liverpool nes seasin, and say all yama- yama tins wey hapin no go stop de club
Posted on: Fri, 09 Aug 2013 07:15:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015