Hi dearies, couldnt help but borrow dis... Before u dey use BB - TopicsExpress



          

Hi dearies, couldnt help but borrow dis... Before u dey use BB dey buga!... Now everybody don get BB. B4 u go dey use ur Camry dey buga!... Now boys don dey use am do cab. B4 u dey use ur plasma screen dey swell!... Now dem don dey use am watch ball for Buka. B4 u dey use ur Ipad dey swagga!... Now na heavy load to carry commot 4 house. B4 u go dey use Brazilian hair dey form big girl!... Now secondary school students don dey wear am throway. B4 u go dey go vacation for UK dey talk pass urself!... Now boys do dey buy first class ticket dey enta London just to go lick ice cream. Bottom line no dey over do like say dat tin no go reach anoda person hand... All na vanity... E dey fade like Aba jean... No 4get say Tortoise car na big man motor b4... Notin wey come wey no get expiring date... Even the life U have na borrow u borrow am. HUMILITY... Na the best choice.
Posted on: Fri, 01 Nov 2013 09:21:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015