I Love My Country: Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by - TopicsExpress



          

I Love My Country: Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge#200 and win a big ship. Then Airtel go com follow say, recharge #100 and win Benin republic. Glo, go just kuku say... Recharge 500 and win Nigeria bcos their colour na Green. Na only nigeria EFCC gΘ announce say person chop money and dem noooo gΘ announce say d person don Dεy prison. Na only for Nigeria you go see fish inside MEATPIE Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey say: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill. (what a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from red to green. Na only for Nigeria Pharmacy Shop dey sell Coke, Recharge Card, chin-chin, puff- puff, ogogoro and beer. Wetin u no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world, trust me.
Posted on: Tue, 03 Jun 2014 16:49:33 +0000

Trending Topics



HER WARNING!!! Flash Flood Warning in effect from 12:55
Egypt manager Bob Bradley has named his 26- man squad ahead of
Had a great time yesterday at West Liberty Homecoming and at
Transfer Mahal Merusak Karier Pesepakbola (BAGIAN 1) Tidak
The entire Katjivena family.I know that u have lost a loved in

Recently Viewed Topics




© 2015