I don die. Wetin these online Networking and Dating and Marriage - TopicsExpress



          

I don die. Wetin these online Networking and Dating and Marriage dey cause people? My guy don fall Victim at a dying point abeg we need advise. My guy met a profile here on Facebook, No Picture but the profile Gender states Female( traditional princess) that is why she cannot display her picture but that she is competiting beautiful girl In Nigeria. People dey fear to Believe, my guy put head. I warn am but him no gree. Him say Love na Blindness and deaf. Over 8months dem dey chat dey talk on phone me self i don foolishly hear the voice many times. Now them don agree to marry, my guy don prepare to do everything together and he sent money to them for everything. Now we don enter their family bcos na this friday e go dey shelle. My people d babe na princess true true but she no Tall pass( AKI AND POPO) ugly like(IGBUDU MONCKEY AND UWAEZUOKE) my guy dey swear give everybody now. Wetin we go do my people? confussed tinz on my okporo head isi now. MC TOLLGATE
Posted on: Mon, 07 Oct 2013 12:04:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015