I enter this Cross- Country bus from Abuja to Benin yesterday. - TopicsExpress



          

I enter this Cross- Country bus from Abuja to Benin yesterday. As we dey go for road one man for back say driver I am impressed. The driver com say thank you sir. We never reach Lokoja wen the man tell driver again, driver I am impressed. The driver come thank the man again. Before we comot for Lokoja the man don thunder again say, driver I am impressed. The driver come say, thank you very much sir, I very much appreciate your compliments. The driver begin dey fire the bus dey go come dey feel like James Bond. As we reach Okene the man shout driver stop this bus, stop this bus, you mad, you wan kill person? As driver stop the bus the man run comot like Usain Bolt enter bush. We rush follow the man make we see wetin dey impress the man. Before we reach where the man dey we hear pra pra pratata pro pro! Na there we come realise say wetin the man wan tell driver be, driver I am pressed I take God beg all of una... If the English hard small, una fit talk am for pidgin. Meanwhile... I m impressed right now, make I rush discharge... I dey come.
Posted on: Fri, 22 Aug 2014 20:44:04 +0000

Trending Topics



of
Mjaaaaft! Boll! 16 Shtator, 2013 | Postuar në:
From Candlelight Concert for Epilepsy Awareness: A new study
(إِنَّ الَّذِينَ يَكْتُمُونَ مَا
Vincent Van Gogh once said, If you hear a voice within you say
JAKĄ RECEPTĘ na MŁODOŚĆ ma ta 70-letnia PANI ??? NIESAMOWITA
Dear friends, it has been some time since i posted, i have been
Eppi Sukhu KriyaSisterAngels Whisper (Sherri Columbus)Tracy
Ο Εκδικητής Φάντασμα - The Wraith
POST NEW YEAR REFLECTION: Last night I watched the live telecast
I understand the need for answers about how another feels about us
Gold Sports Charm Pendant Tennis Racquets Crossed W Ball Good
The pregame hospitality tables will be open in the gym lobby from
OPEN TODAY 2-4PM 4106 Forest Hill Avenue $485,000 Victorian
There is only one thing I fear--- That in the end, I shall

Recently Viewed Topics




© 2015