I greet you oh. The eye wey you take read this post no go see - TopicsExpress



          

I greet you oh. The eye wey you take read this post no go see death oh. Yes oh, you go live pass methuselah for bible, In fact, you go live for this earth sote’ them go say you be vampire because every day no so so fresh and elegant you go dey. Hehehe but no stay this earth reach when this world go become “illuminati globe” because na you and Satan go drag land for Lagos. Na like this I take dey go house one cool evening na him I jam many people wey I never see before for my street. As a guy man I just dodge come take cover for one aboki shop. Na there I dey come get the tory say officers come arrest my neighbor wey be Livinus. Them say na the boy the give ogbonge information to all the men of the underworld wey dey come terrorize us for we area. Na so Livinus take use him mouth confess all the information and robbery wey him follow dem go. Na that time my eye come open because na me for be their next target as recently, Livinus dey come my house steady even when I no invite am. Na so him go carry me go buy me drink so I go dey high, him go come dey ask me questions wey dey personal to me, whereas na rebel him be, shoOOOoo.! My brother my sister tis world wicked oh, so make you dey careful for the kind people you dey associate and give information to. Na here I go drop my tory for today. I no fit shout because person wey carry water for mouth no dey chop turkey at the same time. Till next time, God bless una.
Posted on: Wed, 14 Aug 2013 07:28:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015