ILEYA MEAT............: hAHAHAHAHAHA...LWKMD As d sun set in - TopicsExpress



          

ILEYA MEAT............: hAHAHAHAHAHA...LWKMD As d sun set in ds mornyn,naso i see ram for sky..dem no need tel me say today na ileya cos d aroma wey dey enta tru my window blind,na he lele...i cum use style shift 2 my window tak inhale d burnt smoke of d he-goat wey my neighbour kill. As i manage stand-up,i sha go grt dem outside say aw parole dey go nw. Naso dem tak serve me poundo-yam with egusi soup and goat-meat...chai...only me?..God go bless una. B4 i chop am finish,soup don stain my boxers...walahi...dem stl cum add a bottle of Turbo-king join am for me...i dey rub my belle wt one hand,jst dey laff dey go. Before i chop d food finish,all ma nigga 4 town don dey halla m say palm wine don dey ground wit beef,mak i dey com sharply. U knw nw,na ileya alone u fit see free food,meat,drinks...naso i call bike widaut washn my hand,say mak e drop me for pipeline. Na on top bike i dey tak use my hand rub my pocket..i cum dey use my finger tk bring out d hidden goat meat for d corner of my mouth. As i reach d place,na d berbecue first attract me...i manage grit my guys.. n see money speaking. Naso smoke of cigar, weed dey fly inside air....omo dis one na die...who no go,no go know. Mak i pause dia first...i sha continue to dey chop anytn wey i see...dey drink alomo with palmmy... E com reach one level,e be lyk say i wan vomit,d tin no come...weather na vomit or na gas i wan gas,i no know...abi i wan shit,i no sabi as e dey do me...i sha go siddon for one angle dey roll my tummy. I pull off my cloth,com ask for toilet from one guy....as i reach toilet,e get one useless guy wey dey dia...d shit don dey catch me so teyy i no fit endure....i wait,knock,rake....notn wey i no do dis guy no commot oo....as i look beside m,i jst see small space under d staircase,na dia i pull off my boxers take shit......i com use my boxers cover d shit,wear my jean trousers bak.......omo...naso i gboriwole to anoda parry ooooo..... MIDDYS LIBRARY Ileya is a good ooooo
Posted on: Sat, 04 Oct 2014 19:00:09 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015