ISOKO-ABRAKA ROAD WHO WE GO BLAME? We carry our yansh go up - TopicsExpress



          

ISOKO-ABRAKA ROAD WHO WE GO BLAME? We carry our yansh go up dudurudu take salute everybody, dis picture wen dey under so na Abraka road via owhelogbo. Na dere our oga SSG Comr ovouzori Macaulay dey fly that time wen de road dey good shape. As Akpati take see the road last weekend im say na from ABK rach Ozoro now, na almost £800 naira instead of the normal £200h. Wetin cause am na dis bad spot wen dor scatter full ground like akamu. Dis other road wen dem dey do for Irri so, na who be d contractor self, dis road naim face Irri roundabout. Emore road, we see say d contractor dor dey put gutter for the side, what next? E get story wen dey our file for studio here, the Koko na those pipo wen dey..... Make unu hold una peace. Meanwhile we dor get new reporter, we go introduce am 2mrrw. Him go write with Queens ENGLISH how unu see am, make we employ am? ISOKO MUST BETTER IJN
Posted on: Mon, 04 Nov 2013 17:37:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015