If TECNO fit ping first before NOkIA --- who tell you say all ur - TopicsExpress



          

If TECNO fit ping first before NOkIA --- who tell you say all ur mates weh first u start fit make am b4 u finish ? If CIVIL DEFENCE fit carry gun first before ROAD SAFETY----who tell u say na by how far,na by how well !!.... If GARRI fit sell pass INDOMIE after all the adverts----- who tell u say u must dress Unclad or indecent to jst get married ? If OgA JONATHAN weh no get even common Aba shoe/sandals before,but now em dey wear 3 different shoes per hour --- who tell u say u go continue being poor ?...over hope dey jareee If INSPECTOR GENERaL of POLICE fit comot police for high way and check points thereby stopping dia N20 rogger -----who tell u say Naija no go better again ?...no be me talk am oo If 2face fit finally repent and marry Anie - ---who tell u say ur current boyfriend no go marry u ...stick to him and dnt be distracted wit all d yahoo boiz weh dey around u. If my street fit get light frm (4am -5am) ----- who tell u say hope no dey for constant light in naija by 2025 ?....ok naa If Judas fit sell his boss Jesus ------ who tell u say ur best friend or lover no fit do worse than this?.....be careful! If them fit tie cow with rope upon all em size but must use chain to hold dog follow body, who be that wey dey tell you say you worth nothing? U re priceless jare,say u no get money now no mean say u no go get am 2moro. Finally,I know ure gonna make it in life so keep believing in ursef for every man is made and allowed to thrive for purpose. As we are in dis june,May GOD open a new gate of breakthrough,healing,long life,peace and salvation in our life and the life of our family members in JESUS name. May we all go out and come back safely to the glory...nice day to all of us.
Posted on: Thu, 05 Jun 2014 05:53:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015