In WAEC examination, Akpos was asked to complete the following 1. - TopicsExpress



          

In WAEC examination, Akpos was asked to complete the following 1. He who fights and run away? Akpos: E don surrender be dat na, na fear catch am 2.A rolling stone? Akpos: No fit just dey roll, na person push am. 3. He who lives in a glass house? Akpos: Na rich politician e go be. 4. A stitch in time? Akpos: Dey prevent further tear tear. 5. Birds of the same feather? Akpos: Na the same mama born them. 6. One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am. 7. A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if nobe barbeque. Dem plenty for chicken republic. 8. Half breadt is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar. 9. A journey of a thousand miles? Akpos: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or what is the common difference between a bird and a fly. Akpors: a bird can fly but a fly can not bird
Posted on: Sat, 17 Aug 2013 08:20:59 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015