Joke: Sister Kate On d 8th of August 1998, As i dey waka close to - TopicsExpress



          

Joke: Sister Kate On d 8th of August 1998, As i dey waka close to Lasu gate for Lagos State na eim i meet one chick wey her name na Kate, she come introduce me to her friend wey her name be Faith say two of them na class mate. She ask me wetin be my name i say my name na Fegolate. I come tell Kate say i go like to take her on a date. She come ask me say mehn wetin be ur pocket rate. I say i’m a big boy and my pocket rate dey very great. So we come decide to fall in Goldin Gate. The drinks wey she take na almost one crate wen dem bring food for her she begin dey salivate. I ask her where she dey stay she say na for estate, She neva finish one plate she begin ask for chocolate. I come ask Kate of her age she say she be 28 but deep inside of me I know say i be one and eight but since i don make myself implicate i no get any oda choice dan to make myself co-operate. So na eim we come leave Goldin Gate for half past eight. Wen i dey escort Kate i con check my pocket rate Na eim i see say i don spend pass wetin i estimate, Instantly Na i plan for my heart against Kate say Man I must retaliate. The next day as i go their house for estate, Wen i dey parabulate I come decide to stand on top of cement close to their gate na i see their gateman wey dey sell cigarette. He come ask me say; Mehn my guy who you dey wait? I tell am say mehn i dey ask of Kate. He say make i come make we negotiate Na eim i give am one thousand eight. He say thank you sir but you no go fit see Kate. Na eim i ask am say why? He say; Shebi you neva hear say Kate Father na Magistrate if him come out he go begin dey Legislate and at the end of the day na him i go Implicate. Na i tell am say; Okay my guy give me back my one thousand eight. He say ermm.. As him dey try depreciate na eim Kate Father wey be magistrate come come out from their gate. Instantly as i see am na i prostrate. The man come dey Interrogate wetin me and the gateman dey relate. Na i tell am say; Good day sir! My name is Brother Fegolate and i am from Apostolic Faith my mission here is to ministrate to your daughter Kate. He say; Well my son, When it is late i don’t appreciate people coming to my gate. But since you say your name is Brother Fegolate from Apostolic Faith your mission here is to ministrate to my daughter Kate and due to the way you prostrate go in through the gate before you suffocate and you will see Kate. As i enter the gate i begin dey Jubilate, Na i see Kate She too, She dey Jollificate. She come take me into her room make we go relate. When we dey relate she begin dey show herself. Instantly Na i begin dey meditate come dey contemplate As i try to migrate Na i remember say Kate na 28 Instantly my Love for her con depreciate And when i remember say Jesus Christ say make we no deviate Na I vex jump on top of Kate because of wetin i dey HATE!
Posted on: Wed, 31 Jul 2013 14:19:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015