Just For Laughs: If you read Mathew 5: 25, you go read - TopicsExpress



          

Just For Laughs: If you read Mathew 5: 25, you go read something like this... Agree with your adversary quickly while you are are on the way with him, else the adversary at any time hand you over to the judge and the judge deliver you officer and you are thrown into the prison. Akpors dey always deceive police anytime him dey drive. Him dey always waka with addresses on a piece of paper anytime him dey drive. One day wey dem stop am, him commot name from him pocket begin ask olopa, officer, biko na national theater I dey go. Officer giam directions. Na so him escape any kolafication. Akpororo come tell am say, if you try am for Benin, you nor go escape o! As him dey travel, as part of him trick, him carry poster of obituary put for motor. For one junction for Benin, olopa stop am, oya, park! Akpors come down, waka go meet olopa dey cry, officer, na my grand mama die o! Olopa, eyah, still park well. Who don die don die. Where ya partiKOLAS? Akpors, as my grand mama die so, I forget am in a hurry. Biko, allow me now! Officer hand am over to dem office, dem lock Akpors up for prison for 2 weeks. After 2 weeks wey dem release am na him Akpors find out say the poster wey him tear put for motor to deceive the olopa, ashey the old woman wey dey the poster na the police man grand mama! If you read Mathew 5: 25, you go read something like this... Agree with your adversary quickly while you are are on the way with him, else the adversary at any time hand you over to the judge and the judge deliver you officer and you are thrown into the prison. You see say even bible don warn us against olopas dem? Now, if you see police for road wey stop you, try settle your matter with am there ON THE WAY before him take the matter further wey you fitto land for prison.
Posted on: Tue, 13 Jan 2015 08:48:59 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015