LIFE IN LASPOTECH MAIN CAMPUS, IKD I miss dose security men wey - TopicsExpress



          

LIFE IN LASPOTECH MAIN CAMPUS, IKD I miss dose security men wey dey feel lik say dem be JTF especially dt yellow CSO man wey dey sitdon for 1st gate. Mehn, it hasnt been easy, I miss dt Studio Area wey Mass Comm students dey sit down look who dress well and who no dress well come school I miss all dose Kpomo sellers kai! Dose women Kpomo no be here 3 for #50. I miss dt Ijebu woman egg roll 4 SPTS-E I miss all dose strolling arnd frm department 2 department (where boys dey always go find ASAP and Basic chicks) Hmm, cant imagine, no more impromptu classes & test, (I miss dose my dose women wey dey giv receipt for sch fees, wey dey always form like say na dem own the sch. I miss dt Skye bank inside sch wey no dey ever get network Eheni! RUSHING OF BUS 4 1st gate, I miss u oh (Ive 4gotten my running & high jump skills) I miss 1st gate (where Laspo girls go wear bum short come buy N100 food, yet na dem form pass) I miss watching UCL, LFP football matches for Podium @ nite. I miss Iya Egun Beans for 1st gate, that woman beans no be here. I miss Mama T beer parlor & Astoria bar where boys dey buy 1bottle of beer chill for hours. I miss Abule, Jacuzzi Vila, (Igbo & SK centre) where boys dey high steady I miss Container & Laspo guest House where Lecturer dey deal wiv wayward Laspo babes I miss Activity Centre (where dem dey chop our money 4 assignment) I miss those photographers; wey tink say na evryday I go dey snap photo. More to follow.... S/O 2 all Laspo Students Ex & Present
Posted on: Thu, 07 Nov 2013 08:47:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015