Laffs... I remember that year wey etisalat bring pple like Fela - TopicsExpress



          

Laffs... I remember that year wey etisalat bring pple like Fela Durotoye, Sam Adeyemi, Niyi Adesanya and some other motivational speakers come uniben. Plenty people go attend am. As dem dey comot, many pple just dey ginger dey carry book say dem go read! Many pple begin dey shout, dey jump up and down say them go change the world! Ehehhhehehe.... Even Night class full! Everybody wan read, put their life for their hand, succeed whatever comes. Okay o! As that week end, ginger dry! Pple 4get about decision. If we come see one guy, ask am say, Oboi! How far na? U no dey change the world again? The guy go frown look you, for where e dey crash for bed, dey wait make hin beans boil, e go answer you, tell u say, Guy, u think say na so e easy? I resemble Lord Lughard? Abeg no dey threaten me. Kiekiekiekiekie
Posted on: Thu, 21 Aug 2014 10:58:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015