Life get as e be oo.. at a stage na breast go dey hungri u, anoda - TopicsExpress



          

Life get as e be oo.. at a stage na breast go dey hungri u, anoda stage na only food dey ur mind, next thing u don dey look gyal as soo many tins dey cross ur mind, b4 u know it na moni and hawz go dey ur head, as e dey b, u go understand say u nid wife and chilren oo.. still on still u don get eye for one chieftancy title for ya villa, u no go kno as pikin school feez go turn u into economist, and na so e be wen u go dey collect pension. chai.. very soon madam go turn oga, as u no fit waka witawt walking stick.. ur eye go dey give u photocopy of tins in original form, ur ear go hybernate small.. chai.. life sef! one day, e go b say oga don travel go yonda. my guy... life no easy!!! chief freddy say so.. peace!!
Posted on: Tue, 24 Sep 2013 10:23:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015