Liverpool Oga pata pata don tear for Arsenal dey enta dem anyhow - TopicsExpress



          

Liverpool Oga pata pata don tear for Arsenal dey enta dem anyhow as per de kain parade wey dem dey do for de market wey dem drop for Luis Suarez on Wednesday as de Gunners sef come add small kulele join de £40 wey dem bin fes drop. De wahala be say dem just add onli one pound on top de 40 million wey show to take open dey padlock wey dem take lock Suarez kontrak wey tok say if any kishi show pass 40 milla, e means say de strika fit yarn wit de team wey show. Henry tok for hin twitter accout ( na hin proper account ): "Wetin dem dey smoke for Emirates sef? ( Arsenal dey play dia matches for Emirates) Suarez sef bin supose siddon discuss wetin dey wit coachi Brendan Rodgers for Melbourne on Wednesday wia Liverpool dey do pre-seasin. Arsenal don alreadi drop for de guyman but Liverpool no gree chop knuckle on top de matter. Suarez bin enta Melboune on Monday take jam hin Liverpool teammates dem. Hin still get six matches wey remain for de 10 match ban wey dem ban am becos of de bite wey hin bite Chelsea defenda Branislav Ivanovic for April 21, but hin go stilf it play for dia pr-seasin friendli wey dem dey play.
Posted on: Thu, 25 Jul 2013 21:33:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015