Luv dy veri strong especialy wen u met d rite person. Luv go - TopicsExpress



          

Luv dy veri strong especialy wen u met d rite person. Luv go change ur entire life. Luv go make u adjust in many ways. Luv go shape u in2 a diferent person. Luv go make u change ur bhaviors. Luv go make u do tings wey u no tink say u go fit do b4. Luv go teach u many tings like how 2 care 4 luv, how 2 sacrifice 4 luv, how 2 give witout say u dy expecting anytin in return, how 2 apreciate, how 2 dy patient, how 2 luv urself… Luv go make u discover urself. Luv go make u quit sum of ur habits. Luv go make u limit urself 4rm sum kind frnds wey u get. Luv can even make u cry. Luv go give u evalasting & uncurable pain. Luv go make u dy jealous. Luv go make u dy do strange strange tings like make u kil person or make u kil urself… Luv go break ur heart & na only luv go fit heal am bak. Luv go make u go places wey u no eva ting say u go fit go 2 b4. Luv go make u met new pipo. Luv go make u promise wetin u no go fit do. Luv go make u lie & again e go also make u lose ur respect. Luv go make u dy heartles & sumtimes u dy wicked . My padi dem, e no easy 2 find true luv in side dis world. But in case God blis u wit one, make u try apreciate am, hold am wit delicacy, make u value & respect am, make u do am make e dy colourful,make u admire am , protect am,make u sacrifice 4 am & fight 4 am. No easily let am go bcos of smal wahala wey una go fit range wit in d 2 of una. One luv my pipo na Shanks talk xo Peace.......
Posted on: Sat, 26 Oct 2013 00:47:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015