MESSI BREAKS LA-LIGA RECORD! VAN GAAL VINDICATED BY WELBECK SELL!! - TopicsExpress



          

MESSI BREAKS LA-LIGA RECORD! VAN GAAL VINDICATED BY WELBECK SELL!! CHELSEA CRUISED PAST WESTBROM MESSI don yakata the whole LaLiga record with three goals in the Barcelona 5-1 win against Savila. Him don score pass former Athletic Bilbao forward Telmo Zarras wey score 251 goals. Messi dey on 253 in just 289 games. Him na the Oga at the top of the highest goal scorers for Laliga now. 5Gbosa for Messi! Manchester United sitdown deep to soak the initial gara-gara of Arsenal. Then they begin to bite Arsenal while blowing them small small breeze. Before Arsenal go feel the full bite, 2goals don enter. We don talk am before say e dey easier to score Arsenal when them dey in possession of the ball because their defenders dey leave open space wey fast players or players wey sabi pass fit attack. Add the second goal of Swansea, Chelsea and United to the one-on-one wey Di Maria miss, you go understand weitin we dey talk. This na why Mourinho score Arsenal 2-0 after him gift the possession to them. Wenger needs to understand say good football and possession no dey equal to a WIN. The earlier the better oo Chelsea show say them be the Oga at the top when them arrange Westbrom 2-0. The good thing on top of the win and the 3points na say Mourinho players rest well well even though the match dey on. Chelsea reduced gear and intensity after scoring 2goals because them get 7 matches before December 30th. Them go start with the Champions League on tuesday. And with the way them dey go, Mourinho players no go tire during this busy period. And if them no tire. If City, United, Liverpool and Arsenal continue to dey get mixed result, Chelsea go just close eye carry the EPL.
Posted on: Sun, 23 Nov 2014 06:16:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015