Mede mede xtra My people we hail una dis freaky friday ontop - TopicsExpress



          

Mede mede xtra My people we hail una dis freaky friday ontop Sports Radio. My people 11 days after Ronaldo kpake im 3rd Fifa ballon Dor,Bayern Munich attacker Franck Ribery wey come 3rd for 2013 own don come out to para say im feel say e no go dey possible for any player to kpake the Fifa Ballon dOr as long as Cristiano Ronaldo and Lionel Messi still dey around and e don yarn again say for im mind o say the award na all about politics. Messi and Ronaldo don kpake the last seven editions of the award between dem and Ribery believe say no two way dey for any player no matter wetin e don achieve go fit win am and e don carry warning give say very very soon for future im go respect im old age and no attend again. Hmmmmm, My people na how una see dis matter so? Inside all the ogbonge players wey full for world now, na which one/s go fit break dis Messi, Ronaldo Dominance? Oya make we yarn in a freaky way. No insults o
Posted on: Fri, 23 Jan 2015 13:39:33 +0000

Trending Topics



href="http://www.topicsexpress.com/ALRIGHTY-FRIENDS-AND-FAM-Heres-video-number-2-and-its-a-topic-10101806130526796">ALRIGHTY FRIENDS AND FAM!!!!! Heres video number 2, and its a
What a blessed day to give back. Things r seen in a whole new
UNIVERSITY PARK, Pa. — Penn State is offering scholarships to
Heaven Ive been wanting to cover this for a while now and who
Free video reveals HOW to explode your primary biz opp

Recently Viewed Topics




© 2015