Midweek Premier League gbege go sweet: Na real ogbunigwe e go - TopicsExpress



          

Midweek Premier League gbege go sweet: Na real ogbunigwe e go be for David Moyes as hin go carry hin Manchester United team go jam hin foma team Everton on Wednesday for Premier League. United dey nine points for Arsenal back afta dem draw with Cardiff City and Tottenham Hotspur, but Moyes, wey siddon for Sir Alex chair wen de foma manaja retire, say make nobodi get any shaking. E concern me say we no dey near Arsenal de way wey I for want but e go soon setul, hin tok. Plenti oda games dey ground oh. Premier League tight dis seasin no be small and we go try to do dem bumpa to bumpa as we dey enta de nes year so. United go miss defender Nemanja Vidic, wey dey suspenshun. Arsenal, wey be baba for tabul go jam Hull City as dem kontinu to dey show swagga waya Cardiff City 3-0 las Saturday. We don dey show beta form and dat one sef na good sign, manaja Arsene Wenger relate. Chelsea, wey dey four point for Arsenal bak afta dem beat Southampton on Sunday go travel go Sunderland wey dem sef don begin dey show say dem dey as dem don komot from bottom tabul afta de draw wit Aston Villa. Fulham go start life unda dis new manaja Rene Meulensteen on Wednesday as dem go jam Tottenham Hotspur as fire don dey pile for manaja Andre Villas-Boas bodi. De guyman bin vex say na media pipu and Spurs foma Chairmo, Alan Sugar say dem all dey do amebo say tins neva setul for am, but hin gree say de match on Wednesday go hard no be small becos de two teams go dey find point by fire by force. Liverpool go wan shake de dust wey cova dem as Hull City scatta dem for ground take wound Norwich City, as Manchester City wey show swagga beat Swansea City las week go waka go meet West Bromwich Albion. I for like make I enta de new year for numba one for tabul, but if dat one no do, make e no pass say na three points go separate us from de numba one, Manchester City manaja Manuel Pellegrini yarn. Newcastle United, wey dey numba six now dey go Swansea City, as Southampton go open dia door welcome Aston Villa and Cardiff City go enta one trouser wit Stoke City dem. Crystal Palace wey dey las las for tabul go play West Ham for dia own match on Tuesday. Na all de midweek matches be dis: Crystal Palace v West Ham United Swansea City v Newcastle United Southampton v Aston Villa Stoke City v Cardiff City Liverpool v Norwich City West Bromwich Albion v Manchester City Fulham v Tottenham Hotspur Arsenal V Hull City Manchester United v Everton Sunderland v Chelsea
Posted on: Tue, 03 Dec 2013 11:25:13 +0000

Trending Topics



e for Home Use, Tax and
Today I found myself reminiscing as one of my closest friends,
Ich lebe allein mit KET63 GEBOREN 2.7 . 1950 JACHRE IST ALT ALT!
Awesome Deer Creek Hills Winter Service Day! 21 docents, 2 SVC
For all of you who do and did not know, received a phone call from
Menu combinado de sábado (Entrada + Prato Principal +
Hey, I am in a bit of a pickle everyone. I received a Virginia
Receptionist Vacancy - Seasonal Position Windermere Full time

Recently Viewed Topics




© 2015