My frnd, How everything today? I hear say you dey murmur, you dey - TopicsExpress



          

My frnd, How everything today? I hear say you dey murmur, you dey complain and you dey grumble say you neva hammer, you no thank God ehn! You think say to see September 2013 na moinmoin? Boko Haram reach your side? You dey for Dana Crash? Aluu community pple catch you? You no how many way die for 2012 and even from Jan till now? Ansa me naaa *...* God give you good health. Naija no good, Naija no good: you dey use blackberry, ipad, Iphone, Galaxy tab, Android and laptop, If at all you neva get money buy car or build house. Abi you don see where person wey dey coma for sick bed dey whatsapp? Abi na blind man wan change DP? or comment for facebook status, you still dey complain there? Abi you don see where dead body dey read facebook and ping or whatsapp for coffin? You better Start thanking God now... if you read this message and you no re-post am that means you no dey appreciate GOD.. Oya send am to all your contacts. Thanks to GOD oo. Lord I thank you ooooo. Me don send my own ooo...
Posted on: Mon, 30 Sep 2013 19:33:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015