My people! E get wetin dey disturb my mind ever since wey I dey - TopicsExpress



          

My people! E get wetin dey disturb my mind ever since wey I dey grow up dey come and I never still see changes. Why we too like to dey look down on ourself? If person nor see work do, we go laff am say e nor get work. If he come try manage get work weda for Emu Bakery or Daddy fast food or anywhere wey e take see work since our Government nor know wetin be employment, if he get work where he still dey see small money take dey hold imside, we go still laff am say which kine work u get? Dat one na work? My people! Who like make he vex say I talk am but na we by ourself dey use our own mouth dey cause our problem. E nor get condition wey dey permanent. As Dangote dey so, if God say he go go rent one room to stay and store for Otokutu dey sell yam tomorrow, na so e go be, forget d billions of dollars wey he get! God is not moved by what we drive! God is moved by what drives us! So u wey dey laff person bcos he nor get, nor worry, ur turn dey come! Wetin I know be say, food wey person go chop nor fit pass am! Even some of our girls wey be like people wey go soon use their krokro eye waka naked for road all in d name of fashion, dem nor dey help matters! Dem go paint lip, paint eye, wear artificial eyelashes and wear Brazillian hair. Make I ask una one question! How many Brazilian girls dey wear Nigerian hair? Na mumu una be! Suppose una still dey humble unaself now e 4 still good! Una go see una papa mate una nor fit greet bcos say una don dey follow man wey get money pass una papa! If boy wey dey work for Emu Bakery or wey be waiter for one beer parlor or wey dey sell fuel for filling station toast una, una go swear for am, ask am weda slippers nor get size? But if na d boy wey u see for inside Camry or Range Rover, weda na im get am or not, una go start to do busy body! Once some kine girls see where dem park Range Rover or Camry dem go just do like say dem wan buy something around d place just to do notice me! Nor be una fault. One babe try am wit me dat year for Marcopolo! As she dey come out me I dey park! She see me! Me sef I see am! Warri boy nor dey carry last! Na so I enter. I buy wetin I wan buy, still dey there for like another fifteen minutes on call and I dey observe d babe for outside! She stand for road dey form who dey wait for Red Cab. As I come out I use style look her again I observe say she get mission for my side! I start moto! Ovwoho! Lai! I nor dey run agbo matter beside nor be me get the moto! I nor dey carry, talkless of use another person moto carry road-side babes. Wen I still get moto, if I dey drive I nor dey carry any babe wey paint eye, paint lip like say na fine art she dey do for Abraka. She go wait for Uduaghan Bus or trek if she nor fit! Omote! If u must attract a good man, u must be good in and out! Wetin come dey vex me pass now be say, all those so-called yahoo boys and levels-men wey dem dey run follow bcos of BB, Ice-cream, eatries and small money, dem nor go gree marry dem later on. Na better girls wey get home training wey go fit help dem manage d money wey dem get well, dem go dey find and na d same guys wey dey work for Emu bakery or filling Station wey u nearly swear for dat year na im go come still marry una why bcos, the young shall grow. My people! If anybody dey laff u bcos u nor get or becos u nor get reach am, na d person know! Make he laff! U, just believe in THE MOST HIGH GOD! THE ONLY OSUIVIE! THE OROVWEFETCHA! THE OROMAKPEJE! BABA GOD! Believe in him and d sky wont be ur limit! Una doh!
Posted on: Thu, 16 Jan 2014 10:31:55 +0000

Trending Topics



www.topicsexpress.com/A-Nairobi-court-has-issued-a-warrant-of-arrest-against-topic-3512562308232">A Nairobi court has issued a warrant of arrest against
Samples of snow and rainwater from around the world show that the

Recently Viewed Topics




© 2015