NAIJA STYLE. Chelsea don climb reach de top of England Premier - TopicsExpress



          

NAIJA STYLE. Chelsea don climb reach de top of England Premier League wit de 2-1 wey dem take beat Aston Villa for dia house for Stamford Bridge. Becos say Chelsea get match for Uefa Super Cup for August 30, dem come play dis match so dat Chelsea go find time go play Bayern Munich for de Super Cup. De game hard Chelsea no be small as Villa sef no gree at all at all, dem push dem reach till mortuary time. Chelsea start de match wella as dem comot carri de game enta Villa side and dem come force Vila defenda Antonio Luna to score hin own house for de sixth minute from bal wey Eden Hazard arrange. But Aston Villa sef no just siddon, dem comot dey play dey try find equaliser as as haf time dey reach, dia Belgium strika Christian Benteke find beta space hamma sht wey Petr Cech no fit catch. Andreas Wiemann sef for equalise for Villa but hin no place hin heda well well from cross wey Luna bring, and small wahala come dey for Ciaran Clark as Demba Ba use leg jab am for face wey make plenti blood comot and de guyman sef gast waka comot from field. De Stadium come loud as Ivanovic nod freekick wey Lampard take to come make am 2-1 for de 73. Villa kontinu to dey fight to find anoda gol, as Benteke cross bet bal reach Andreas Wiemman but Petr Cech save am well wit hin leg. As match dey drag reach mortuary time, Villa come dey para for refuree as e be like say John Terry touch ball wit hand inside eighteen, but refuree Kevin Friend no send dem as Mourinho and hin boys kolect de three points from de match.
Posted on: Sat, 24 Aug 2013 14:45:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015