NFF don tell Obuh bye bye: 21 Jul 2013 07:31:52am The Naija - TopicsExpress



          

NFF don tell Obuh bye bye: 21 Jul 2013 07:31:52am The Naija football federation (NFF) people wey dey control all de football matta for Naija don accept de letter wey de foma coachi for de Flying Eagus, John Obuh carry give dem dat him no dey work again. Oga John Obuh neva even enta Naija wen de man don tok say him deywaka as him Boys no fit pass de knockout stage for de 2013 fifa U20 world cup wey shelle for Turkey. Na Uruguay bulala Naija 2-1 for de carry go matchwey dem play for Turkeyand naso plenty people kon dey yab de coachi (Obuh) dat de man no sabi at all. Some guymen even tok say plenty of de Boys wey de foma Sharks coachi carry enta Turkey for de U20 world cup don pass de age wey Fifatok for de competition. Chris Green wey na him be de chairman for de NFF people on technical matta na im kon yarn us for supersport dat de NFF don gree make Obuh dey carry him bag dey go. Oga Green also tok say na even all de coaching crew go follow dia master wey be (Obuh) waka as de man yarn saydem no wan anybody among dem again. “We don say bye bye to Obuh as we don accept de letter wey him give usand na all him assistants dem chop koboko as we don fire all of dem make dem dey go,”. Naso Oga Green tok
Posted on: Sun, 21 Jul 2013 07:18:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015