NITEL VANDALS!! 16 Suspected Pipeline vandals don dey arrested by - TopicsExpress



          

NITEL VANDALS!! 16 Suspected Pipeline vandals don dey arrested by soldiers Soldiers don arrest about Sixteen suspected pipeline vandals for Oguta local council area of Imo State. De soldiers also recover and hand over to de police plenti plenti vandalized pipes, equipment, a Mack truck, one L-300 Mitsubishi bus and a trailer load of 40 feet eight-inch diameter pipes wey dey valued for over N5milion. As dem dey carry de suspect kakiri, Mrs. Joy Elemokode wey be de Police Public Relations Officer, PPRO,yan say de command arrest three of de six people wey allegedly vandalize underground optic cables wey belong to de pipu of Naija Telecommunication Limited, NITEL. “Items wey dem see korokoro from de suspects na Mercedes Benz truck wey dem load with optic cables wey worth about N10 million and one Toyota Corrola car wey dem load with ogbonge vandalism equipment. Also yan say de police nab de NITEL vandals for Enyis/Trinity Road, Oguta, Mrs. Elemoko con give credit to de army wey dem deploy come Agip flow station at Akri, for successfully rounding up de 16 pipeline crooks. In a similar development, de Command storm Ihiagwa, Owerri West local council area of de state con arrest six cult suspects wey dey allegedly connected with de shooting and killing of Mbachu Samuel Chigozie, on youth corps member wey dey serve for Cross River State. “De Command self don dey worried bicos cult gbeke for tertiary institutions don increase.
Posted on: Mon, 26 Aug 2013 11:49:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015