NO BI ME DO AM Which kain life be dis Wey man pikin no go - TopicsExpress



          

NO BI ME DO AM Which kain life be dis Wey man pikin no go live in peace Na crime say i bin born Wey my life wan roast like corn. I no born see my mama No be say my mama even know my papa The kurukere life wey she live Na im she born me leave. From one aunty house to another Dem been call dem foster mother If to say my mama been dey My life for no be ball for dem to play. To chop food i know wetin i see E be like make Mikel obi score goal for Chelsea To see cloth wear na die Fela even better pass me before e die. I come know say i gats survive on my ability Oyinbo call am to face your reality I know get paper or skill And I no get mind to carry gun kill. So i follow enter road stand Dey pray say na here my luck go land Black and black come put us for van Squeeze us like sardine fish inside can For court, dem say we be disgrace to we nation Say our hand-work no worth emulation People begin ask why i bin do am Na im i wan yarn dem say no be me do am.
Posted on: Mon, 29 Sep 2014 19:13:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015