NOON NEWS/UPDATES Better wahala nai happen yesterday for inside - TopicsExpress



          

NOON NEWS/UPDATES Better wahala nai happen yesterday for inside Sapele Stadium as some Public Servant organize one kind protest to take disrupt d function of yesterday as dem express their grievances. Oga Udughan don troway frown face give dem as he don warn dem to stop dat kin tin. Na some members of the Delta State Traders and Market Women Leaders Council led by Mrs. Queen Aminomah wen be staff of Sapele Local Government nai lead d pipo as dem carry placard in protest to met our Governor yesterday for the venue of the polio eradication sensitization campaign to demand for micro credit loan. The Governor con vex well, well as he express disappointment say the Leader of the group na senior administrative staff of Sapele Local Government as he note say the State micro credit scheme nor be for employed pipo but na to boost traders businesses. As we dey update so, the Chairman of the Delta State Local Government Service Commission, Chief Patience Okwofo don summon Mrs. Queen Aminomah wen he lead d protest yesterday, to appear before d Commission today. Madam I TOO KNOW AMINOMAH, Just pray make u nor pass here lost ur job as u go use okamuka take do protest for function wen nor concern protest. nton We dey troway warning dey give all dos Boutique wen dey after Ecobank for Boyo Rd, like say u dey go Market, make unu dey maintain unu store space. Unu don dey push unu boutique dumb-baby take dey block road, all of unu for d line, Cynthia Love ur own worst, Collins wen e head round like football, na ur dumb-baby come out pass. Unu nor even suppose dey cross d gutter let alone to dey put d dumb-baby for road. Anytin outside d gutter na illegal. So make unu maintain. U wen dey immediately after d bank i never want face u but make u use ur mind b4 i go naked u bcos na u b d youngest old man wen suppose cordinate dem. Nigeria Police Force Sapele chapter dey pay their last respect to one of deir fellow worker wey die during service. He corpse depart Sapele General Hospital wit convoy of Police van. Dem branch Sapele main station as dem troway countless gun shots to honour the officer. Our team nor fit capture dis event well becos Army dey dere too. Nor be small carry drive d Hilux dey drive for Road all in d name say dem dey mourn. Dat Car wash wey dey after Seplat for side of High Chief Felix Anirah new compound wey community build for am done get one new store wey dem dey call Radaj Beauty World.Dis store situate for d structure wen Govt mark X and na one fine Girl get am. As Govt mark am d owner don use e own paint take mark am good. Dis act na bad one oh and make d owner nor vex wen Govt go use swampbuggy pass d Houx oh. Becos na place nor good for dat building. The woman Police wey tanda for Okpe Rd by Amuogodo dis morning wey dem dey call Evelyn just dey control cars anyhow. She almost use two cars jam and her uniform dirty like primary school pikin. DPO make u dey try dey check all dis pipo time to time so that dem go dey neat dey go resume work. Make unu join us thank Omasan Olololo as e don finally join hands support dat woman financially wey her shop burn for Amukpe axis. (Knee down Omasan) Today I pray make God bless you and favour you as dey do good becos of my fear and also make God blind ur eyes whenever fine Girl waka pass ur front, so dat you nor go dey use sins dey block ur blessings again IJN. say amen na? Amen. Report reach our studio say some filling stations for Sapele town still dey sell fuel N120 for one Litre, while AP Filling Station dey sell normal prize. Hand go touch unu soon. Dat dirty pig bleaching girl wen dey sell fruits for Bus stop wen face Texaco fuel station for New Rd by Abeke Rd near Kigho Store, as u say ur gbu nu seke nor go rest so, na me go helep u rest am. Ur kponyor don dey read meter with fast speed. Na so, so bike nai u dey enter. U dey go doke dey leave ur fruit wen u dey sell, up to d extent say u go leave dat ur yawo boyfriend wen get gorimakpa for UR store, u go pass back go doke for he head. If na ur kponyor nai BEDC take dey supply us light, nai be say we for dey get constant lite becos ur kponyor na constant doking nai u dey use am for. Change for good b4 Gonorrhea go use u take do skyscrapper. Solomon Abeke! Solomon Abeke!! Solomon Abeke!!! God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 21 Mar 2014 12:10:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015