Na Lagos I go ooo, I come see sometin outside my house when i - TopicsExpress



          

Na Lagos I go ooo, I come see sometin outside my house when i see one clean beautiful girl come out from her SUV dey cry dey kneel down dey beg one slim bobo wey be like say him never chop for months, the babe just dey beg dey cry dey follow the guy dey tell am say she no need money, she no need brazilian wigs,she no want shoes,house or anything, she say she no even need the SUV all she want na him love, his kisses and his warm embrace, guys the babe just dey shout dey cry, when i hear these words my heart stop, my head spark and my brain burst, the guy no even dey look the babe sef na there me i vex say if this guy no value this girl well Right now me i don fall in love be that so make i go claim this girl but As i near there, one man just touch me for back say oboy abeg no block the camera.. . . . RUBBISH na one new #NOLLYWOOD film dem dey Shoot for there. . Hahaha Happy 1st sunday friends
Posted on: Sun, 02 Nov 2014 09:59:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015