Na only for Naija you fit win Aeroplane by loading #200 MTN - TopicsExpress



          

Na only for Naija you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge #100 and win benin republic. Glo, go just say... Recharge 500 and win Nigeria because there colour na Green. Na only for Naija you go see fish insideMEATPIE Na only for Naija we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Naija PHCN dey sey: Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (what a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Naija Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in the world...?? YES or NO
Posted on: Thu, 11 Sep 2014 05:58:35 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015