Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 - TopicsExpress



          

Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green. Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE" Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. Na only for Nigeria PHCN dey sey:- Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill. (wat a pity) Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station. na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet? Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey... Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself. Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED" God blss my one nd only country"lol
Posted on: Tue, 17 Sep 2013 23:08:11 +0000

Trending Topics



le="min-height:30px;">
Wishing I had better news. George is currently in Acute Care.
A couple watching an IPL match on the TV together. After five
Proud to announce that Paper Dolls is up and running again , after
Nous sommes souvent obligés de rencontrer et de vivre avec des
so, this is me ! ref :youjustgetme/?page=self_test_new Your
Nouvelle loi en vigueur de 1 janvier 2015: CHAPITRE
I have had enough news coverage of this mess already. A clergy

Recently Viewed Topics




© 2015