Naija don kwalify for nes year Chan wey go hapin for South Africa - TopicsExpress



          

Naija don kwalify for nes year Chan wey go hapin for South Africa even as dem lose 2-0 to Ivory Coast Elephants for match wey dem play for Ivory Coast side. De Supa Eagles don kwalify for 4-3 aggregate afta dem win de fes leg wey dem play for Kaduna 4-1. De match no start well at all for Naija as Ivory Coast comot like say fire dey dia body dey enta Naija anyhow as soon as refuree blow whistle make match start. Yawa come gas for de 6th minute as Azubuike Egwuekwe make mistake for defence nod ball pass Chigozie Agbim, Ivory Coast strika Kevin Koelly Zougoula thank am, pack the ball put for Naija net. De early gol come ginja de Elephants dem as dem kontinu to dey carri matter go for Naija side. Chigozie Agbim hand full well well as de golkipa dey try to stop de Ivory Coast boys. Cheick Moukora take beta shot wey nearly rest for Naija net but Agbim no gree, e palm de ball comot for kona kick as Godfrey Oboabona dey rush back to take see say de ball no rest for Naija net. Matta come enta from bad to woss as Ivory Coast come nak anoda gol for de 24minute from penariti afta Kano Pillars midfielder Rabiu Ali pack Ivory Coast playa for inside eighteen. Kevin Koelly Zougoula, wey score de fes gol no make mistake as hin hamma beta shot from de penariti pass Agbim to make am 2-0. E be like say de gol pain Naija as na dat time dem comot start to dey tap sef, Ifeanyi Edeh miss beta chance wey Sunday arrange am and Rabiu Ali sef miss anoda one wey Gomo Onduku do gif am. De secon haf sef na helele as Agbim becom customer for de Ivory Coast strikas, dem test amm well well for de 49 and 59 minut, but de kipa stop all de balls wey dem carri come. Stephen Keshi comot Ifeanyi Edeh wey forget hin boot for house come put Alhaji Gero and de Enugu Rangers strika come put small shine for Naija attack dey hol ball well dey disturb de Ivory Coast defenders dem. Chigozie Agbim do beta tin for de 85 minute wen Diakite take shot wey nearli enta net but hin pam deball comot. Chibuzor Okonkwo wey enta for Olufemi Oladapo hol Naija defence well well as de Ivory Coast playas comot dey try to find de gol wey go carri dem play de Chan wey South Africa go host for January 2014. Naija manage hol dem till game finish take kwalify 3-2 for aggregate to take join oda teams wey don kwalify for de competition wey CAF dem dey hol everi two two years. Na Naija line up be dis: GK: Chigozie Agbim, Godfrey Oboabona, Benjamin Francis, Azubuike Egwuekwe, Solomon Kwambe,( Kunle Odunlami-80 ) Olufemi Oladapo, ( Chibuzor Okonkwo-69 ) Sunday Mba, Rabiu Ali,Gomo Onduku, (Alhaji Gero-53 ) Etebor Oghenekharo, Ifeanyi Ede. Reserves: Daniel Akpeyi, Ezekiel Mba, Ayo Saka, Joseph Osadiaye,
Posted on: Sat, 27 Jul 2013 21:57:18 +0000

Trending Topics



ass="sttext" style="margin-left:0px; min-height:30px;"> Black Friday 2013 16GB 4X4GB RAM Memory for HP ProLiant Series
#SHOUTOUT Oba Darby *****JULY 18TH***** *****BLURR
You are calm and logical, but not unemotional. You are an
These dudes are so lucky. Tonight they Play the David Letterman
HOSPITAL ARREST NA NAMAN??? HUWAG NAMAN SANANG MAKA-BAIL...
A plane was about tocrash and there were only 4parachutes in the

Recently Viewed Topics




© 2015