Naija people and their questions sometimes ehn, u go weak: 1. - TopicsExpress



          

Naija people and their questions sometimes ehn, u go weak: 1. You see identical twins, you still dey ask na twins be dis? Answer: No bros, na copy and paste. 2. Nepa brings light and everyone in the neighborhood shouts up Nepaaa! My guy asks me Na light be that? Answer: No, Na Holy Ghost fire! 3. You see person dey vomit o, you dey ask am you no well? Answer: E well, e juz dey practice how to vomit...olodo! 4. Someone sees you dancing and asks so you sabi dance? Answer: No, I dey practice madness! 5. You just dey wake up person come ask you you don wake? Answer: No, I come buy bread wey I go chop for dream! Abeg no spoil the fun, add those questions wey dey vex you too!
Posted on: Tue, 02 Dec 2014 08:57:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015