Naija small pikin team wey dia name be Golden Eaglets don kwalify - TopicsExpress



          

Naija small pikin team wey dia name be Golden Eaglets don kwalify for de 2013 FIFA U17 world cup final for United Arab Emirates (UAE) afta dem knack Sweden 3 kondo for dia semifinal game on Tuesday. Sabi strika, Taiwo Awoniyi na him be de guy wey waya de fess gol wey wicked Sweden for de 21st minute. Na vex na hin Sweden small pikin take start de match for de fess haf and naso dem kon dey knack Naija attack, but de Eaglets no gree open yarns for dem. De match kon dey tough dey go as de two of dem dey enter diasef anyhow bifor Kelechi Iheanacho kon tap de pass wey Awoniyi take hamma dem wen de match enta 21st minute. De gragra wey Sweden pikin dey do kon cool down small wen Naija waya dem de gol, but na for small minute na hin de gol take pepper dem for body bifor dem kon start to de attack Naija again. Sweden try well well make dem ekwalise wen de fess haf remain small minute to kpai, but tufiaka na hin Naija boys dey shout as de odeshi wey dey dia body strong well well. Na for de second haf na hin de Golden Eaglets kon wound Sweden patapata for de match as Naija waya dem 2 gols for 2 minute. Sabi defenda, Samuel Okon take beta shot waya de second gol for Naija, and bifor Sweden know wetin dey happen, Chidera Ezeh don hamma dem de 3rd gol for de 81st minute. Naija now don tell Sweden say dem no be dia mate as una remember say na 3-3 draw na hin dem play wen dem fess jam diasef for de group stage. Walahi, Golden Eaglets golkeeper, Dele Alampasu save Naija for dis match and na everybody kon dey hail am say de guy sabi well well. Oh boy, kon see how tears kon full ground like rain wen de refiree blow hin final wisu as Swedenplayas kon dey cry. Naija Golden Eaglets go jam Mexico for de final match on Friday. Mexico skatta Argentina 3-0 for dia own semifinal wahala. NA D NEWS BE DAT OOO
Posted on: Wed, 06 Nov 2013 13:21:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015