Nigeria funny jokes. ~Na only in 9ja you fit win aeroplane by - TopicsExpress



          

Nigeria funny jokes. ~Na only in 9ja you fit win aeroplane by loading N200 mtn recharge card. ~Very soon etisalat go say recharge N200 and win a big ship...lmao.. ~Den airtel go cum follow sey,recharge N100 and win Benin republic...omg... ~glo go just kukuma say recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na green. ~na only for 9ja PHCN go sey: win a brand new generator by paying your nepa bill(wat a pity)... ~na only for 9ja people dey horn for traffic light make e quick change from red to green. ~na only for 9ja pharmacy dey sell coke,recharge card,chin chin, puff puff,and beer....#chai. ~na only for 9ja you go see a graduate of mechanical engineering dey do nysc for police station. ~na only for 9ja you go see someone wit bold5,x3,ipad2,and Nokia N8 all @ once...you b bill gate?? Abi na u invent internet?? ~na only for 9ja you go see a graduate of law dey work as generator repairer. ~na only for 9ja u go bye coke, dem go tel u to return d bottle and even hold ur change...#chai. ~na only for 9ja you go see madman dey control traffic, pple wey dere head correct go dey obey. ~na only fr 9ja president go even senior d country herself. ~na only for 9ja you go see advert from native doctor on how to make quick money. ~na only for 9ja you go wish someone hapibirthday and he go answer same to u...lol. ~na only fr 9ja obituary poster dem go saymama has relocated..lmfao. ~na only for 9ja nepa office dey use generator. ~na only for 9ja dey go show u fake product and original product in one shop. Im very proud of my country...we are exceptional#dancing. Share, comment and like.... WE ARE PROUD! Lol.
Posted on: Fri, 25 Jul 2014 13:06:05 +0000

Trending Topics



v class="stbody" style="min-height:30px;">
Black Friday and Cyber Monday Sales @ MoKo Sony Xperia Z2 Case -
Their findings, published online by the National Institutes of
Artsmith, Inc. Mens Tank Top (Dark) If Mom Aint Happy Aint Nobody

Recently Viewed Topics




© 2015