Nna eeh! The kind grammer and football analysis wey i don hear for - TopicsExpress



          

Nna eeh! The kind grammer and football analysis wey i don hear for football viewing centers dey make me laff so tey i wan piss for my bed...hahahahaha.. We dey watch African nations cup last year in a match btw Nigeria and Ivory Coast. Na im one guy said.,Nigeria and Ivory Coast dey disturb themselves here cuz i know SPAIN OR BRAZIL go still win this cup at the end of the day..hahahaha...Abeg umunnem IS SPAIN OR BRAZIL AN AFRICAN COUNTRY??..hahaha We dey watch a match recently btw Sunderland and Manchester United,..the match was 1....1 as it was coming to an end. One angry Man Utd fan said..I no blame Sunderland,we go show dem how to play football when they visit OLD TRANSPORT...hahahaha. Abeg pals,When did OLD TRAFFORD changed to OLD TRANSPORT??..hahahaha... A serious argument dey go on yesterday at the place wia i dey watch Chelsea match. The argument na between MOURINHO AND VAN GAAL who beta pass?...na im one Man utd fan said..,Chai! See dis guys o,.una no know football at all.,SO UNA USE MOURINHO DEY PREPARE VAN GAAL...hahahahahaha,..as everybody begin laff at him for the mistake wey him make cuz he suppose talk COMPARE instead of PREPARE,..na im the guy said,PLS NA MISTAKE,I MEAN HOW UNA TAKE MOURINHO DEY COMPENSATE VAN GAAL......hahahahahahahaha. Abeg pals,WETIN Concern COMPARE with PREPARE & COMPENSATE??..hahahahahaha. Dis guys wan tear my belle with laughter. I sometimes like to watch matches at viewing centers cuz they cant stop to make me laff....hahahaha U CAN SHARE UR OWN EXPERIENCE OF VIEWING CENTER DRAMA HERE?? #FOOTBALLisFUN #HAHAHAHAHAHAHA #MYwaist O! #JIMMYcarterNNEM
Posted on: Sun, 14 Sep 2014 07:00:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015