No Names... Guy, sorry o. I hear say you dey hospital. My - TopicsExpress



          

No Names... Guy, sorry o. I hear say you dey hospital. My brother, na so I see am o Pele o. How the accident take happen? Accident? My guy, na jeje I dey house dey skype with Jane... You and this Jane. Una still dey? We don go far for the mata, so tay, that day, she don off cloth. Na so I tell am say I wan take toilet break. As devil dey do hin thing, as I dey toilet na so NEPA take light. As NEPA take light wey gen no on, na im madam come down to enquire. To cut a long story short, na so she see Jane for my computer. Instead make that one continue dey moan make madam think say I dey watch blue film, na so the fool begin holla say who be dat? Say shebi I tell am say I never marry...
Posted on: Wed, 02 Apr 2014 12:46:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015