Noon News/Update. Late Pa P.K Ogbimi Burial last week experience - TopicsExpress



          

Noon News/Update. Late Pa P.K Ogbimi Burial last week experience d gadamentation of old Barristers,Judges,Politicians and individuals. The Family experience War that morning of the Burial and as we dey talk so,d kasala norva end,as Pikin wen P.K Ogbimi nor know wen e dey alive just burst out from sky,becos we all know say dem must share Property. Honey Ogbimi just dey use Hon. J Overah head like Toy,as all her Boyfriend mudiaga for d background,while Overah dey do Inlaw things wit e cheap dry lace wen e wear. Tega Oge Weds Patricks for Labelle Event Centre on saturday. Na God go helep me punish d DJ wen nor sabi change Music. Dis same DJ nai use e hand scatter Pablo Cyril Otoboh a.k.a Dear Mama Laundry Wedding for club wen make all Pablo guest run go Tongalo Marriage go dey enjoy Music,after dem drink Pablo drink finish. NOLI Table water pikin traditional marriage waka enter night d previous day,as the Groom almost forget e marriage day,due to say Hangover wan kill am. Labelle A.C don dey weak as crowd dey oppress d A.C. The food sweet,but Drinks nor buku and d pipo wen share drinks dey use face dey share d drinks. Na so water full d place like say na Waterboard dem 2 for d work. Doris wen dey work for Life Flour Mill don finally marry dis Friday wen pass so,close to Akpeki Crescent. Na coded marriage and na few pipo nai attend. Wen we interview Mr Okonofua e say d only tin wen e tell God before e retire na say make God give Doris Husband,and e dey very happy say God don finally answer e prayer. Wen we interview Doris she just dey cry dey Thank God,becos she don almost lost hope before,as she dey think of how to be Sista wen nor dey born for deir Church. Street Light Repairs go on for Sapele Main Street Lights wen dey under the State supervision and care. The Repair na out of the normal maintenance wen d Company dey do periodically. A GEM GONE SO SOON. OUR BROTHER, FATHER, FRIEND & UNCLE. Late Mr.CHARLES EDOKPOLOR, aged 57years. Alias AMINA EBIREN. May your gentle soul rest in peace. Na last week dem do the Burial and na for Oghara ground nai dem rest e body put. ATP catch fire 2nites back at about 8pm. Na the quick responds of Fire Service from Seplat and State Fire Service nai rescue the situation. Park folk lift burn and top shade for wood storage partly burnt too. No life lost,but i dey suspect some workers as things dey lost for d yard now. Okada thief don enter Church now and na for Catholic Church yesterday nai one young man wen go church for close see say e Bike don vanage. The young man still wear black and black up till now dey mourn the Okada,becos e say na e only means for livelyhood. We dey use dis update they call on all Churches and Event Centers to get Tag wen drivers and Riders go dey collect wen dem dey pass thru deir gates,and wen dem dey commot dem go drop the Tag back. Rob Robinson Enebeli ur own na to dey waka so so Marriages dey go wak pipo food and drink free drinks. U go dey waka like who get Gonorhea dey spread legs dey waka,like Late Old Uncle Malorin a.k.a Dr Coconut. Try reduce ur marriage attendance,so dat u fit focus do ur own. We regret to announce the Death of Late Goddy Ovieghara. Dis young man dey escort HAPPY KABAKA wen cum from Austral dey go back to Lasgidins as e get flight to pick by 10 Oclock,na serious Accident happen for near Jebu Ode. The driver and owner of d Infinity Jeep Blessing Okete sustain Neck dislocation,why Happy injure for hand. As d Motor dey samasult nai one winch Iron go shook Goddy for head. Na so e take die on d spot. We don receive e body,as we don deposit am for Mortuary. May e soul rest in Perfect Peace. Jerome Ezeoba wen be Sapele strong defender. Wen play Enugu Rangers and Eyimba of Aba,papa die for UBTH last week after brief illness. As we dey update so d Family dey meeting dey choose date for the Burial. May e soul rest in Peace. Amen.#J
Posted on: Mon, 27 Jan 2014 12:11:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015