ON A LIGHTER MOOD! Before-before-before, and even till - TopicsExpress



          

ON A LIGHTER MOOD! Before-before-before, and even till tomorrow, if person too dey form or dem too dey pose, or even dem dey behave as if dem be some angel or demigods on earth, we use to remind them thus: say if dem no dey shit/pooh ni! Or whether dem no know say, even the queen of Oyinbo too dey pooh, even though dem talk say she and all she people be White, and dem even ontop that one sef, prefer to do that things we dey yhawn about in the para...., inside some White stuff, anyway fact remain say, the thing na still wetin e be; the thing-dirts!! Having said that, the new thing wey just land feli-feli this a.m nain be; instead of telling whoever dey over-carry demsef, whether for home o, office o, Abi na for servant-like government circle o, please gentle remind dem say, Abi dem no dey sleep, and if dem dey sleep why dem no know say, at such time, dem die the death, and dat na even minus God factors o, so if that no make sense to dem, then be sempe say dem no be human being, but beast! Peace!!! So una dey sleep, wetin una dey yanga pose for, come dey feel say na you own everyone, comot for here jhoor!!!
Posted on: Sun, 14 Sep 2014 10:34:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015